Different Marketing wey fit help your business & how you fit take use them

Share This Post

As we say make we carry Digital Marketing reach street (Grass root), we no forget our oyinbo people dem dem wey they find our scatter scatter english hard to read. If you wan rush read this article for english, u go gats read this one or make you watch all the videos wey dey this article as you they read

If you enjoy this one wey we dey yarn you for pigdin English and go like make we dey do the video for pidgin, abeg type “Abeg give us video” for the live chat wey dey the bottom right of ya screen.

Oya!! Make we begin touch light the matter

Better marketing or advert no be about big big grammar, abi fine fine design, na say make e carry confirm tori and better call to action


%65 of marketing wey dey really jawo (Conversion) no be for the welcome tori, but for the close marking (follow up call).


Better marketing process na the one wey go make people sabi you, make them fit relate with you, make them padi with you, or give your brand correct respect among him competitors.


We get two ogbonge options wey dey for marketing, make we sharply torchlite, and recommend the one wey better pass for your business, and wey no go tear your pocket base on one or two logistics wey we don get with past clients them. The ogbonge two options na: Digital marketing and Retail marketing


1.Digital Marketing:
I notice sey whenever dem mention digital marketing this days, our mind na sey na only online things, abi social media, abi sey you must to get website, abi you must get internet. No be lie sey all this ones sef follow body, but Digital marketing pass wetin you think o. Edon even dey now for over 100 years, and all this times nothing like social media or internet don dey.
As the name take be, digital marketing na any kind marketing wey they use any form of digital application take pass message wey dey for ground

We get two types of digital marketing:  one na the Offline Marketing and the other na Online Marketing.

Both of this two types na better way to reach people and yield better conversion, but we go first torchlite the offline marketing 
a.Offline Marketing: This kind marketing sef get him own different types wey be conventional media placement, prints, and mobile marketing.

i.The Conventional media placement: this na the regular placements wey we dey see for TV, Radio, Newspapers, Bus branding, billboard etc 

This type  na for big big companies them with better budget even though them no go fit align the success like that

If your business na small or medium scale business,  no even think about billboards o, na laff dem go just laff you based on say e no sure sey you go get the value of your money back. Even them the big companies sef don wise up, na why we dey see too many vacant billboards for road again this days
But if you sey na conventional media placement you wan do, always remember sey na about 3 focused strategies to showcase your message because na only few seconds you get to win the attention of viewers, whether na brand awareness or brand engagement you wan get

These 3 strategies must to align with “Simple Brand/Selling message, Curiosity/Humour plus better Call to action
When your advert don too carry plenty information put for the viewers dem face, dem no go see anything, so your advert must to find way reduce distraction.

Ogbonge Brands like GTBank, Samsung, and Airtel dey sabi play this game well well. 


Even though sey we sabi sey graphics and quality dey important to deliver better result, na conversion truly matter for ROI & unto say simplicity na em dey show profesionalism
ii. Prints:  This kind marketing wan resemble conventional media small, but na mainly small scale enterprises dey use am pass. (Make your placement simple well well and carry better call to action like (Call Now, Register now, Scan to Buy etc.)

Swipe to see why this banner ads will be effective

            
Example na fliers, banners, T-shirts etc. Even though sey print dey share the same strategy with conventional media, entrepreneurs and business experts must dey carefull when dem dey use this pattern.
Unlike the conventional media wey dey always use advertising media  or publishing firms take pass message, you fit do your prints yourself or even give graphics designer expert. (You fit call better person to helep run this package: 07081557995 or use Printivo)
Because of this, you must  to identify all the legal obligations, environment restrictions for brand t-shirts and fees wey you go need pay to regulatory bodies wey dey govern these activities. Example na- LASAA (Lagos State Signage & Advertising Agency), in case you go need make legal payment to fit use branded cars, signage, banner and posters. 
Better example, na one yawa wey gas with one of our client activation, “BLUDOT Xplorer” for Shoprite Mall Ikeja around that kind 2015, wey we pay fine of N25,000 because sey we break the  rules Shoprite set for activation, as we use branded T shirts take market for mall without proper authorization. #ShameTheyCatchUsHere. You better no go learn the hard way



iii.  Mobile Marketing: example of this type of marketing na: Personalized text, voice calls, USSD/short codes, IVR, Mobile app.

            Download Video

Personalized Bulk SMS na jara to the normal Bulk SMS, where you fit personalize your message give plenty people wey waka come your store.
For example, you fit send personal appreciation message give plenty customers with just one button.
(Hi Bayo, we want to say a big thank you for purchasing XYZ, get 20% discount for your next purchase. We would love to see you again).

Abeg, make this one they English o except your customers na street

You fit give them awoof for your next purchase sef, this go even helep boost your business plus say, he go jawo. Use talk.pob.ng for this kind service.

Voice Calls: This na recorded voice message wey you fit send give multiple customers with just one button wey you still fit use your GSM number send.
Politicians for naija dey use this one well well, but make you no go dey send spam voice calls like wetin most network for naija dey do
You no go like waste money or go dey sound like mosquitoes for your customers ear.
You fit also call your customers for their birthday month, wish dem better month of celebration ahead and direct dem to your store for birthday present and better awoof.
You fit also use celebrity take make call give your customers, make them tell your customers how much dem love your products or love you. Na still talk.pob.ng you go use
USSD (Unstructured Supplementary Service Data) /short codes:  this na Global System for Mobile (GSM) communication technology wey dem dey use send text between mobile phone and application program for ya network.
Applications fit be prepaid roaming or mobile chatting, example na GTbank banking code like #737 or short codes for voting/subscription like bbnaija, e fit also be popup messages like the message you they see when you check your account balance.

           
To get this kind application fit heavy small, so I go advise make you run dedicated shared server wey you fit do padi padi with another server user.
If you go like to use this kind of service abi you want make them help you set am up for your campaign, you fit call 08023782509 for more information.
Make Your ad message no pass one sentence with at least one call to action [like “Dial or Text (The Code)”] wey go explain the whole functions and features of the services wey this application dey render.



Make una no forget sey, to set this one up, you go need your dedicated USSD code. 
Check www.ncc.gov.ng make them confirm your letter, when you don do this one, we fit help you with the set up. 
If you want sharp sharp or better money USSD Code, call us make we for fit raise you with one of our codes. 
Interactive Voice Response dey follow work like the USSD but as the name take be, this na voice response system and e go better to use am for just customer services instead of marketing.

Mobile Marketing            

Many of our customers that year like the Mobile applications well well no be small, especially the ones wey get internet shops

Plenty people believe sey mobile applications dey helep keep Internet shops/eCommerce customers or fit helep make customers loyal to your government, but based on logistics & experience, I sorry to yarn you say no be so he be for real life o. (You fit ask Konga & Jumia). 
 Researched conducted by Dazeinfo.com

If you no dey create mobile application for one particular function wey go dey useful to customers like: loyalty reward app, video app, Ubber, games, traveling app etc. then this na uneccesary marketing engagement strategy. 

         

To Build mobile shopping app especially for we Naija people, na better waste of money because email marketingpush notificationssocial media marketing na better and cheaper tools wey you fit use convert customers pass mobile app wey person fit delete comot from him phone if e dey chop too much space for their phone.  

Image source: Sendmsg

         

All the wahala and money wey you take get am, maintain am and do adverts for this application, go be waste by the time customers delete the app from their phone.


No be like sey  this mobile app no good o for internet shopping business, if you must to create this kind of application, he must gat to carry major functions follow body wey go engage customers well well. Like loyalty reward app, make customers fit know sey your app dey designed to dey give weekly awoof or play games to win other better better gifts.
          
My point here be sey, If your company services app no dey solve generally problem like sey travelling app, map, edit app, news app etc. wey na only to sell your products, no go waste your money on top mobile applications.
b. Online Marketing: The online marketing get too many things wey resemble the normal retail marketing but this one na the one we dey run for internet and na him sure pass any other marketing, because you go fit checkmate and measure your result.
Your focus for here suppose be say, where my customers dem dey, how I wan take reach them, wetin dem like? How I go take interact/engage with them and how I fit take maintain better face for market
Dis na the many areas wey fit help you meet your goals online:

·Search engine optimization (SEO) &
.Search engine marketing (SEM)
·Pay-per-click advertising (PPC)
.Content marketing
·Social Media Marketing (SMM)
·Email marketing
·Lead Generation
·Sales Funnel Creation
·Video marketing
·Building Phase: (Website design & Blog Creation, Social account Set up and integrations, automation tools, listening tools etc.)
·Affiliate marketing
   
We go take time discuss all these areas for other posts and videos, so make you subscribe to our blog an YouTube channel to be the first person to get full yarns about all this thing wey we mention for there.
2.Retail Marketing: we get two major kind Retail Marketing; Code Call and Referral Marketing
a.Code Call: This na the kind marketing wey you go introduce your product or services to new prospect (person wey you wan turn customer) wey never know your package abi get anything to do with you before.
We get ogbonge skills and strategies wey you fit use for code calling, wey we go they explain for our other videos, so no forget to subscribe to our YouTube channel and blogs make you for no lost.
b.Referral Marketing: This  na the kind marketing wey you dey introduce your product or services to person wey another person or customer carry give you.
Specific skills and strategies sef dey for this kind marketing, we go discuss am for our other posts and videos. Oya Subscribe

 Meanwhile, this na the key cover areas wey you must reason when you dey apply Code call or Referral marketing:
i.Get your First Approach Strategy: Wetin be that unique first line you sabi use well well to begin yarn with person, Remember sey “Marketing dey more psychological than stereotyped
You must get a one particular first line wey you dey comfortable with and fit easily remember. Even though condition fit make you meet person anyhow wey fit make your approach be compliments, humour, coincidence etc.

You must always get that first line wey go give you moral to continue your yarns enter serious matter. This line must end in question format or lead to my next point (ii)

For example “My name na Omotosho Adebayo, I  dey work with Mutual Benefits Life Assurance, I dey sure sey you don hear of my company?.
ii.Begin Ask Better Questions: to ask  better questions na the salt to the soup wey go sell your product or even get promise, because this na the only effective way you fit take reason the needs and problems of your customer.
IF YOU FORGET TO ASK QUESTIONS, JUST KNOW SEY NA YARN YOU DEY YARN NO BE SELL YOU DEY SELL
iii.Use Empathy & Acceptance: Accepting the feedback of your prospect na silent key strength to the yarn una dey gist, wey fit reduce any form of argument or misunderstanding.
E fit be say you dey take note of him answer, then you go come begin mention am before you start to make your point.
For example, you fit talk sey, If I hear you well, you been talk sey this and this and this na this, abi? 
Empathy for this matter na to respect the views and feelings of your prospect wey go make your sales tori or yarn dey more lively and open.
No matter how crazy you feel sey their opinion dey, make your product or services be another option for them to improve wetin dem don already get for ground 
For example, you fit say,

This na wonderful idea wey surely done deliver xyz results, but if we still look am this way, we suppose fit get better result or save money.

You fit come lay the strength and features of your package (product or services) take solve their problems
iv. Closing the sales conversation: This na the most important aspect, where your use of body language/swagger and confidence go come in. This na correct ingredient to better closing.
Before you start your sales tori, I sure sey you go done get goal for wetin you wan achieve after you na yarn finish. E fit be say na to sell something, or get promise with sure time, or close deal, or get referral or even reschedule for better convenient time and place to yarn
If you carry all this for mind, you go study the body language of the prospect based on all the big big questions wey him dey throw give you and how you dey take answer am.
If you get better response, no fear to ask how many them wan buy or when make you help them start their work
For example, Sir, I fit help you process this one now or make I connect you to  correct person wey fit help you run ham? Na small thing dey involved. 
But for where you get negative response, not forget to ask questions like where and why your customer still no dey clear or why him no they interested for your offer. No take ham personal o
E fit be sey your offer no good reach or you no come at the right time, or maybe money to pay never dey ground.


After you done establish him reason
Then you fit come apply further strategies based on your company plans to help close mark new customers or difficult ones like referral options, installment, trial or other zero commitments like sign ups to keep them for your hand
To end the tori,
No matter, the kind marketing wey you choose, make you always run the beginning with the end for mind
Define your goal, e fit be awareness, interaction, engagement or reputation management. Make your investment at least yield return on investment either in cash or kind.
Even though sey the online marketing na the latest form of marketing, we no fit ignore the retail marketing and other type of marketing. 
Make sure sey you set your goal to reach at least 2 people a day wey never hear wetin you wan offer before.  
To finish yarns, the success of every marketing no be to yarn people about wetin you wan give them but na to close mark them (Follow Up) till them become your customer

Never miss a content like this

Enter your email and we'll deliver this type of useful contents free

More To Explore

How to sell POB Academy Affiliate Courses/Course Bundle

Introduction:  Welcome, aspiring POB Academy Affiliate Marketers! Congratulations on taking the first step towards unlocking endless financial possibilities by joining our affiliate program. For those who haven’t joined yet, you can sign up here. To learn more or watch program demo and see FAQ, Visit our affiliate home page. As you embark on this journey, it’s essential to understand what sets our best affiliates apart. They possess key traits and habits that drive their success: Focus: Our top affiliates focus their efforts on a specific market style, target audience, marketing strategy, and niche. By honing in on a particular area, they maximize their resources and amplify their impact. Understanding Our Unique Selling Points: At POB Academy, we offer over 250 unique video courses designed to help individuals and businesses thrive online—all for the price of one, a significant advantage compared to our competitors. Our courses are meticulously crafted to be short and straight to the point, filtering out the noise and unnecessary details. Moreover, our most crucial unique selling point is our unparalleled support. We provide real-time technical assistance to customers for all our video courses via live chat, ensuring they receive the help they need as they learn. Additionally, we offer implementation support and provide premium tools for free, making it a win-win for our affiliates and their referrals. Plus, all our courses are available on the cloud, allowing users to access them from anywhere in the world using their mobile devices or tablets.  Customer Avatar: Before diving into marketing strategies, it’s essential to craft a customer avatar. A customer avatar is a detailed representation of your ideal customer, encompassing their demographics, interests, pain points, and behavior patterns. By creating a customer avatar, you gain insight into who your target audience is, what motivates them, and how to effectively reach and engage with them. Why Do You Need a Customer Avatar? Precision Targeting: Having a clear understanding of your ideal customer allows you to tailor your marketing efforts specifically to their needs and preferences. Efficient Resource Allocation: By focusing your resources on targeting the right audience, you can avoid wasting time, energy, and resources on individuals who are unlikely to convert. Effective Messaging: A well-defined customer avatar enables you to craft messaging that resonates with your target audience, increasing the likelihood of engagement and conversion. Improved ROI: By targeting your marketing efforts towards individuals who are most likely to be interested in your offerings, you can maximize your return on investment and achieve better results with your marketing campaigns. An Example of a Customer Avatar Representing a Prospect Who Would Benefit from POB Academy’s Product Name: Emeka Age: 32 Occupation: Marketing Manager Interests: Digital Marketing, Personal Development Pain Points: Limited time for professional development, overwhelmed by the vast array of online courses available Goals: Advance his career, improve his digital marketing skills Behavior Patterns: Active on LinkedIn and Twitter, regularly attends industry webinars and conferences Additional Examples Of A Strong Customer Avatar And Their Alignment With Our Target Audience Name: GabrielAge: 28Occupation: Financial AnalystInterests: Personal Finance, Career DevelopmentPain Points: Feeling stuck in current job, uncertainty about future career prospectsGoals: Secure financial stability, advance career in financeBehavior Patterns: Actively seeks career advancement resources online, attends industry-related seminars and workshops Target Market: 9-5 Employees Fearing Job Insecurity Gabriel is a young professional working as a financial analyst in a large corporation. Despite his stable job, Gabriel feels a sense of unease about his future career prospects and worries about job security in the ever-changing economic landscape. He actively seeks out resources and information online to help him advance his career and secure his financial future. Gabriel’s interest in personal finance and career development aligns with the concerns of individuals in similar situations, making him a representative customer avatar for the target market of 9-5 employees fearing job insecurity. Name: SadeAge: 34Occupation: Aspiring EntrepreneurInterests: Business Development, Marketing StrategiesPain Points: Lack of business experience, uncertainty about starting a businessGoals: Launch successful business venture, achieve financial independenceBehavior Patterns: Researches business ideas online, attends entrepreneurship workshops and networking events Target Market: Starting Entrepreneurs Sade is a motivated individual with a strong desire to break free from the constraints of traditional employment and pursue her passion for entrepreneurship. However, she lacks the necessary business experience and knowledge to confidently start her own venture. Sade spends hours researching business ideas and strategies online and actively seeks guidance and support from entrepreneurship workshops and networking events. Her determination to succeed and willingness to learn make her a representative customer avatar for the target market of starting entrepreneurs. What to do with these customer avatars? Now that you’ve identified these customer avatars, you possess a powerful tool for refining your marketing strategy. Understanding your audience’s demographics, preferences, and pain points allows you to tailor your approach to meet their specific needs effectively. For instance, you can determine where to find these audiences online, whether it’s through social media platforms, forums, or specific interest groups. Furthermore, you can craft a brand tone and style of messaging that resonates with their interests and values, ensuring your communications are both relatable and engaging. When developing advertisements, you can select keywords and copy that speak directly to their concerns and desires, increasing the likelihood of capturing their attention and driving action. By employing the AIDA (Attention, Interest, Desire, Action) framework, you can draft compelling messages that address their pains and fears while highlighting the benefits of your offerings. Ultimately, leveraging this insight allows you to create targeted marketing campaigns that resonate with your audience, leading to greater engagement, conversions, and overall success. Additionally, armed with a deeper understanding of your customer avatars, you can seek out courses that address their specific fears or provide solutions to their needs. By offering relevant courses tailored to their concerns, you can further enhance your marketing efforts and position yourself as a valuable resource within your niche. Some of POB Academy’s Target Markets to Create Your Customer Avatars: 9-5 Employees Fearing Job Insecurity: Individuals who feel insecure

How to define your business and target audience
Blog

How to define your business purpose and target audience.

Every business has a purpose that differs from the general notion of purpose which is defining your brand and how it engages with your customer. And also, the major reason the business was established. To understand your business purpose, it is important to separate it from your company’s vision or mission statement.  This is a very important part of the entire digital marketing process, if not the most important part because what we do now will affect all we would talk about later in this article both in content marketing, social media, and digital advertising. In this article, we’ll discuss how to define your brand and target audience by covering these topics; DEFINE YOUR BUSINESS PURPOSE POSITION YOUR BRAND UNIQUE SELLING PREPOSITIONS BUSINESS SELLING PREPOSITION BUSINESS PERSONALITY FINDING YOUR AUDIENCE VALIDATE YOUR BUSINESS IDEA AND NOT EXCLUDING REAL-LIFE CASE STUDY If you are interested in these topics or you know your career direly needs these ideas, then this is the right article for you. DEFINE YOUR BUSINESS WITH YOUR AUDIENCE: For you to define your business, here are some questions you should ask yourself:  Why do you want to make the world a better place? Most business owners believe that the purpose of designing a business is solely to provide solutions to customer’s needs and not to make the world a better place.  Well, this is not wrong because not all companies would have to make the world a better place to be successful. How would you feel if your business is not in the pattern of just striving to be productive but making her productivity valuable to making the world a better place? Let’s take a look at some companies in reality that creatively maximize this notion. Canva: This creative design company donated a large portion of its proceeds from the sales of premium props to victims affected by COVID. TOMS: This shoe-making company gives away a pair of shoes to the needy for every pair of shoes purchased. So, you buying a shoe is you paying for them to send shoes to someone in need. Another question you should ask yourself is; What problem are you solving? For instance, let’s use our parent company “Princesage Online Branding”, and our digital academy “POB ACADEMY” as our case study. POB ACADEMY is a digital institution arm of PRINCESAGE Online BRANDING saddled with the responsibility to simplify digital marketing for business. Princesage Online Branding is a digital agency committed to providing marketing, management, and advertising services to entrepreneurs, institutions, and marketers, using available resources online. Below are the problems and challenges our target market experiences. What are the known Problems or challenges your target audience is currently facing? Princesage Online Branding – Parent Company POB Academy – Training Institution We provide well-structured, Digital Marketing tools and services to simplify, manage, marketing and advertisements. In addition to the training that is proven and tested to improve conversion. Convenience and ease of use are our focus when assisting our customers.Also, we groom and train highly professional freelancers to execute jobs for clients. We take responsibility for business trade secrets and job completion as oppose to other public freelance websites or companies. Create simplified digital training materials, guides and checklist online that can be accessible to business owners, entrepreneur and organization’s employees. Subscribers will get access to actionable steps and guides at their disposal. Convenience to learn at your pace with a wide range of support. Your employees over time can learn, and take actionable steps that will yield returns on investment for your business. After stating your “problems and solutions”, come up with a statement that it’s not technically your mission statement but a statement of your purpose. For example POB ACADEMY is saddled with the responsibility of simplifying digital marketing for businesses to boost conversion and returns on investment. Princesage Online Branding: To creatively use digital resources to simplify marketing, management, and advertising. Thereby, Moving your brand around the world. POCKET REMINDER/ACTION Now you understand how to define your business purpose. Get a pen and paper to write these problems you are trying to solve. Also, don’t forget to state your business solution to the problem statement that would make the world a better place. Now you know the problems you are trying to solve; the next step would be to know how to position your brand. POSITIONING YOUR BRAND WITH YOUR TARGET AUDIENCE Brand positioning is the way you position your brand image in the psyche of your clients. More than a slogan or an extravagant logo, brand positioning is the procedure used to separate your business from the rest.  It is how customers identify and connect with your brand. It is a way of setting up your business to differ from its competitors to be preferred by your target audience. When you think of soft drinks or soda, the first thing that comes to your mind might be Coca-Cola or Pepsi. These brands have positioned their products in the very best way possible above their competitors to dominate the world of soda and soft drinks. Another example of brands that comes to your mind when you think of shopping online in Nigeria are Jumia, Konga, and Jiji, but when you want to run international shopping online, the first brands that come to your mind are Amazon, eBay, and Alibaba. These brands have built their personality and services in such a way that they do it better than their competitors. To better position your brand, you’ll need to understand what makes your brand different from your competitors, and the right positions that would help you sell your products or services better.  How Can You Position Your Brand? There are a few questions that we’ll run through using our brand “Princesage Online Branding” and its digital training institute “POB ACADEMY” as a case study or example.  After reading this article it will be reasonable to fit these formats into your business. QUESTION 1: – What makes you different? ANSWERS: Princesage Online Branding – Parent Company POB Academy

How to use digital marketing to boost your business for business purpose in Nigeria
Blog

How to boost your business with digital marketing

Every marketer needs to understand how to build and manage a healthy brand in digital marketing to promote their products and services using various forms of digital marketing. In the modern world of today, the Internet has opened vast opportunities for businesses. We use our computers, tablets, mobile phones, to access the internet for all kinds of reasons. If you’ve always loved to get started in digital marketing or consider building a digital marketing career, this is the article for you. WHAT IS DIGITAL MARKETING?  Interestingly, when we mention digital marketing, people only think of social media management, website design, google analytics, and more but digital marketing is more than what you think and has existed longer than 100 years. As the name implies, Digital Marketing is a promotion that is planned or dispersed through digital applications.     We can categorize digital marketing into two: Offline Marketing and Online Marketing  a. Offline Marketing: Offline marketing can also be divided into conventional media placements, prints, and mobile marketing. b. Online Marketing: Online advertising has such a lot of similarities to ordinary retail promoting however this is done on the web and can be more successful as compared with some other marketing because we can observe outcomes here, re-targeting and measurable. In this article, we will be centered more around the ‘Online Marketing’  Understanding this listed essential standard of digital marketing will drive you to success. Before we proceed, you’ll need to know what a sales funnel is.  What is a sales funnel? A sales funnel (also known as a revenue funnel or sales process) refers to a buying process through sequential messages that lead customers to a sale. The definition also refers to the process through which a company finds leads, qualifies them, and sells its products to its potential audiences. To further simplify our explanation, let’s look at the essentials of a sales funnel. To further understand the essentials to “a Sales Funnel”, let’s dive a little deeper into what a sales funnel is. Sales funnel is the process you take your prospect (a potential customer) through to finally becoming a loyal client. It is a visual representation of the stages from your prospect’s first contact with your brand to finally closing a deal or purchasing a product or service.  By using the concept of the sales funnel, you would have a lot of audiences at the initial stage of your funnel but subsequently, as you go through the stages of your funnel, your audience will reduce to the most qualified leads that will eventually convert to become a loyal customer. ESSENTIAL SALES FUNNEL A – I – D – A The AIDA model is an acronym for; – Awareness – Interest – Desire – Action A-AWARENESS  We associate this with building your brand, building your personality, and using tools like social media to get your audience to know you.  This is usually your traffic source, it can be online ads, search engine optimization, Tv ads or other convention media ads strategy. Here, you will need to be creative enough to create attractive ad copies that evoke emotions, humor or fear in order to ensure that your audience stays attracted to your content. I-INTEREST  Having an extraordinary content method to get your audience keen on your brand, products, and services. Here, you’ll need to summarize those major reasons why your audience should need your products or services. This can be a realistic or obvious problem they experience at the moment, or you can  state what they are doing wrong to fix their challenges.  Another way is to state an undiluted fact about their current situation to provoke fear or build their interest to need your products or services.  Use storylines to create scenarios, present your brand in the best way possible to suit the perspective of your audience. D-DESIRE  This means creating a personal and emotional connection with your audience, in layperson’s terms, it means moving the person from loving what you give to needing it.  Here you’ll need to tell them how you intend to solve their worries using your content or products. Try not to mention your products but their helpful features. You may build customer’s trust with your statements. For Example: See reference online with Coca-Cola example “share the fun” ACTION  This is different depending on the stage of your customer, initially, this could mean subscribing to your YouTube channel, taking the action to like your Facebook page, or subscribing to your email newsletter, it could also mean purchasing your products and services. As soon as you have established your desire, you should proceed to your call to action immediately. This could be requesting your audience to purchase your products or services, or subscribing to your channel. For example, an actionable button, “Buy Now”, “Learn Now”, “Download Now” etc. or request an action like “Subscribe Now”, “Join Our Community”, “Click the Link Below” In the world today, the AIDA model is frequently accompanied with good RETENTION strategy. R-RETENTION  I’m sure you would agree with me that it’s a lot less expensive to hold a client who has bought an item from you than getting another one. Clients who have bought products or services are substantially more prone to purchase from you more frequently.  You’ll create a personal and emotional connection with your audience when you re-target or follow up with your audience. HOW DO WE GET CUSTOMER’S LOYALTY?  There are different ways to get a customers’ loyalty. Here are a few: Email Marketing: This is the act of sending commercial messages to promote products and services while building relationships with a prospect. It is one of the highest converting tools compared to social media or other content marketing strategies. Email Marketing is a quick and easy way to reach new potential customers and also keeping the old customers. Exclusive Content:  This is you putting up great content for your audience to see. Before this, you must know and understand the problems of your audience. You can publish your content on social media or even post it

Make money as an Influencer
Uncategorized

How to make more money as an influencer on social media

If you’re an influencer, internet celebrity, or content provider hoping to cash outcome 2021 or earn from your followers, then this video is for you.  If you’re an influencer waiting for brands to reach out to you to promote their product, then you’ve been doing it the absolute wrong way because you’ve been putting so much money to waste. Have you ever wondered what’s going to come of you if Instagram shot your account today? Do you own a brand and you hope to use influencers to market your product locally and internationally? If you answer “Yes” patiently watch this video till the end because I’ll show you how you can maximize influencer marketing in 2021 to make more money for yourself. https://youtu.be/lOZ6SWflN_c   Resources: Online Brochure: https://canva.com/media-kits/templates Hosting and Domain name: https://store.pobworld.com Website: https://pob.ng How to withdraw Paypal in Nigeria at a high rate: https://pob.ng/paypal,  Referral Candy link: https://refcandy.refr.cc/princesage

👋 Digital Marketing Blog For Business

Download Ready to Edit Business Document Templates Free


Get all-ready editable templates for any type of business to kick start your business. HR Documents, Sales & Marketing Documents, Agreement Letters, Legal Business Documents.

Select the fields to be shown. Others will be hidden. Drag and drop to rearrange the order.
  • Image
  • SKU
  • Rating
  • Price
  • Stock
  • Availability
  • Add to cart
  • Description
  • Content
  • Weight
  • Dimensions
  • Additional information
Click outside to hide the comparison bar
Compare